下载 PDF
返回故事列表

Nozibele an three hairs 诺孜贝儿和三根头发

作者 Tessa Welch

插图 Wiehan de Jager

译文 Anthonia Ujene

语言 尼日利亚皮钦语

级别 3级

将整故事念出来 本故事尚未有语音版。


Before before, three girls go pack wood.

很久很久以前,有三个女孩,她们一起外出找柴火。


Weda hot no be small, so dem come go river go swim. Dem play and swim inside water.

天很热,她们跳下河游了个泳。她们一边游泳,一边嬉戏,溅出很多水花。


At ones dem come see say time don go. Dem come rush go back village.

突然,她们意识到天已经很晚了,匆匆忙忙赶回村子。


Wen dem don near house, Nozibele touch em neck. E come know say e don leave em chain! E beg em friends to follow am go back but dem say time don too go far.

当她们快到家的时候,诺孜贝儿摸了摸她的脖子:她把项链落在了外面。于是她请求她的朋友们:“和我一起回去找找吧!”但她的朋友们都说太晚了。


Na so Nozibele come go back by emsef. E see the chain na em e tuke go house. Na so e come miss road.

诺孜贝儿一个人回到河边,一找到了项链,就赶忙回家,但天太黑了,她迷路了。


E come see light dey shine for one house far far. Na so e rush go there go knock d door.

她远远地看见有个小木屋,木屋里有一丝光亮。她跑到木屋门口,敲了敲门。


Shoo, na dog open door o. D dog say, “wetin you want?” “ Nozibele come say e miss road, i dey look for were to sleep,” ”come inside, or I go bite u oo! D dog tell am. Na so Nozibele enter o.

诺孜贝儿吃了一惊,开门的是一只会说话的狗:“你来干嘛?”诺孜贝儿说:“我迷路了,我要找个地方睡觉。”狗回答说:“进来吧,不然我就咬你!”然后诺孜贝儿就进了屋。


Dog come say, “oya cook for me” e come ansa am say e never cook for dog before o. Dog come say, “cook, or I go bite you oo!” na so Nozibele come cook food for dog.

狗说:“给我做饭!”诺孜贝儿回答说:“但我从来没有给狗做过饭。”狗说:“快做饭,不然我就咬你。”诺孜贝儿没办法,只能给狗做了一些吃的。


Dog come say, “do my bed!” e ansa am say e never do bed for dog before oo. Dog come say, “do my bed or I go bite you!” na so Nozibele come do bed for dog.

狗说:“给我铺床!”诺孜贝儿回答说:“但我从来没有给狗铺过床。”狗说:“快铺床,不然我就咬你。”诺孜贝儿没办法,只能给狗铺了床。


Na so dog come put Nozibele for work. day by day e go cook, sweep, wash for dog. Dog come tell am one day say, “Nozibele, i wan go see my friend dem. Make you sweep d house, cook and wash cloth before i return.

诺孜贝儿每天都要给狗做饭,打扫屋子,洗衣服。有一天,狗说:“诺孜贝儿,我今天要出门见朋友。在我回来之前,你要打扫好屋子,做好饭,洗好衣服。”


As dog comot, na so Nozibele comot three of her from head. E keep one under bed, another one for back of door then one for d kraal. e come skele go house with speed.

狗一走,诺孜贝儿就从头上拔了三根头发下来。她把一根头发放在床下,一根放在门背后,还有一根放在篱笆上。然后诺孜贝儿用尽全力跑回了家。


As Dog return, e come look e no see Nozibele. Na so e come shout “Nozibele, were u dey na?” “I dey unda d bed,” d first hair ansa. “I dey back of door,” d second hair ansa. “I dey inside kraal,” d third hair ansa.

当狗回到家的时候,它开始找诺孜贝儿:“诺孜贝儿,你在哪里?”第一根头发说:“我在这儿,在床底下。”第二根头发说:“我在这儿,在门背后。”第三根头发说:“我在这儿,在篱笆上。”


Na now d Dog come get the gist say Nozibele don do am wayo. Na so Dog come para run go reach d village. Nozibele bros dem don set dey wait am with heavy stick. Na so Dog do reverse tuke wen no one see am since.

狗明白了诺孜贝儿耍的花招。它一路跑到诺孜贝儿的村庄,但是诺孜贝儿的兄弟们正拿着棍子等着它呢!狗见状不妙,赶紧跑开了,从此再也没人见过它。


作者: Tessa Welch
插图: Wiehan de Jager
译文: Anthonia Ujene
语言: 尼日利亚皮钦语
级别: 3级
出处: 原文来自非洲故事书Nozibele and the three hairs
共享创意授权条款
本着作系采用共享创意 署名 3.0 未本地化版本授权条款授权。
读多啲3级故事:
选项
返回故事列表 下载 PDF